Police kill kidnapping suspect for New York street afta e scream ‘make una free me’

One man don die for New York as police shot am dead right for inside traffic after one serious chase for Coney Island area. The mata happen on top Saturday night when di police receive calls from pipo wey hear say one small girl dey inside one white van, dey scream for help.
According to Charles Minch, wey be Assistant Chief for the NYPD, one woman call dem come report say she hear di girl dey shout “Make una free me!” As the officers dem reach the area, they see the van and try to stop the driver, but the mata turn to hot chase. The driver later mount pavement and start to jam other motor dem for road, which come make the police open fire on the man.
Even though dem perform CPR on the man right there for road, e come die later for hospital. After the dust clear, police come discover say no pikin dey inside the van. Instead, they find out say the whole wahala actually involve one woman wey dey argue with the man before she even comot from the van.
Authorities confirm say the dead man already get record with police, as dem bin dey look for am since last month for mata wey concern illegal imprisonment and domestic violence. Investigation still dey go on to sabi wetin really happen.

